Uju Okeke 0

OYA MAKE WE COMMOT KATAKATA FOR PEOPLE-GOVERNMENT

37 people have signed this petition. Add your name now!
Uju Okeke 0 Comments
37 people have signed. Add your voice!
4%
Maxine K. signed just now
Adam B. signed just now

De world dem dey beg for people-government wey be democracy sake of say e dey bring beta development. For de place wey people-government no dey, plus de body wey dey make am work, people dey suffer bad belle, dem dey use am put katakata wey dey make people fear. Katakata na bad belle wey fit cause another person dem physical, psychological, economical plus sexual palava for de place where dem dey. Any katakata against we brother or sister for any way be bad belle as we law dem talk say na bad thing both for here and for de whole world. As e be, we get beta interest if government dem no take iron hand dey rule, which dey bring bad belle for we people-government.

De things wey go make you know say bad government dey for we place:

  • E dey use soldiers well well for ordinary matter.
  • E dey put fear where media dem dey wey dey make we people suffer.
  • E dey make people dem dey obey oga for top pass we constitution.
  • E dey make katakata dey where opposition dey.
  • E dey carry position give im people wey no sabi wetin dey
  • E dey make government dem dey do things wey law no talk
  • E dey cause government dem dey fight against we people dem right
  • E dey make we people no dey put hand for politics matter as we suppose.

Katakata dey bring we people bad belle for we society. As e be, we follow May 18 Memorial Foundation dey beg United Nations make dem make May 18 every year, de day wey de whole world go dey use prevent bad belle wey government dem do against im people, to help commot anything wey be katakata for where our people dey.

Abeg o, beta people wey no wan katakata for people-government, make una sign dis ogbonge petition.

Share for Success

Comment

37

Signatures